Tuesday 24 July 2018

Poetry: One wife for one man by Aig-Imoukhuede, Frank



I dey try go church, I done go for court
Dem all day talk about di ‘new culture’ ;
Dem talk about ‘equality’ ,them mention ‘divorce’
Dem holler am so-tay my ear nearly cut;
One wife be for one man.
My fader before my fader got him wife borku
Eno’ get equality mapalaver, he live well

For he be oga for im own house
But dat time done pass before white man come wit’im
One wife for one man
Tell me how una woman no go make yanga
Wen’e know say na’im only day.
Supose say-make God no ‘gree-’e no born at all?
A ‘tell you dat man bin dey crazy wey start
One wife for one man
Jus’ tell me how one wife fit do one man;
How you go fit stay all time for him house
For time when belleh done kommot.
For how many pickin’ ,self, one woman fit born
wen one wife be for one man?
Suppose, self, say na so-so woman your wife dey born
Suppose, your wife sabe book, no’sabe make chop;
Den, how go tell man make’e no’ go out
Sake of dis divorce? Bo, dis culture na wayao!
wen one wife be for one man.

12 comments:

  1. Nice poem.... What do u think could be the impact in this poem

    ReplyDelete
    Replies
    1. The core impact of this poem is simply the oppositing factor of an African MAN towards the European culture of one man for one wife. And with some backing point that there reasons why a man needs more wives. It tells us that the disadvantages of having one wife, she tends to take him for granted at times, work could drive her attention away from household duties. By with many wives, every woman would be pleasing to the I husband. No tanga 😁😁😁

      Delete
  2. Yes two and more wife for 1 man

    ReplyDelete
  3. What is the background of this poem please

    ReplyDelete

Had an awesome read? Lets know what you think via the comment section. 😊 Follow us on instagram @EgwudikeCAF